Written by 12:30 pm Blog

Social Media Critic VDM Drops Bombshell After Release From Police Detention.

Social Media Critic Very Dark Man aka VDM has spit fire and venom on Iyabo Ojo, Tonto Dike and musi…
Social Media Critic VDM Drops Bombshell After Release From Police Detention.

Social Media Critic Very Dark Man aka VDM has spit fire and venom on Iyabo Ojo, Tonto Dike and music executive,Samklef, after recent release from police detention.

In an online video, he was quoted saying;
“As you all know, I almost spent 1 month in detention because of a lot of circumstances
First is that I want to give a shout out to the MPHNCCC;the cyber crime unit, you people should do well to follow them, those people while I was in detention, if you see work wey those guys dey do
The kind of money them dey help people dey collect, it’s so sad I was in their own cell but I saw the job they were doing, support them because them dey help me fight cases, dem dey collect people wey dem scam their money
Number two; this thing about defamation of character, Cyberstalking and all that, I sincerely don’t think the police should be involving themselves in all those kind of things cause go look the advanced countries,they go say person do this one, you go sue the person
Why are the police involving themselves in gossips;this one say that one say…sue…then if the person doesn’t appear in court, then the court go order make them go bring the person
Now, me i have 5 counts against me;
Number 1;Samklef
Number2;Tonto Dike
Number 3;Iyabo Ojo
Then ofcourse the police
If you remember the first time I was detained, okay I talk something against the DIGs’, I was detained but guess what, after that I was taken to the inspector general of police.
Now when I got there, this man spoke to me like a son
He no look me like say em get influence and power to do and undo
You know…he spoke to me like a son;’fight for something good, if you have a problem, bring your petition, we would sign it’
Then I told him;’Sir, if I bring petition to the police, they always take time, sometimes they don’t respond’, then he said; ‘from today, bring your petition, if they don’t do it, come to me’, he spoke to me like a father
Apart from that, me and police no get issue cause them dey help me help people, as I dey like this there’s no money wey I no go collect online from person, if they scam me, no bother yourself, I go collect that money, the connection don dey, the police are willing to work with me anyday, anytime
But you see those other three people wey dey for the count; Iyabo Ojo say VDM said me and my daughter dey knack one man to get money, this one,that one…YOU AND YOUR DAUGHTER DEY DO AM!
Cos if you can come online to say my papa knack animal take born me, dey call my papa and mama animal;wow!
And you say you and your daughter go stay because you be queen mother;OGUN KPAI YOU!
Ogun go kpai you Iyabo, add am to the court case
Tonto Dike said;’Ehh, he called me Gistlover’ What are you? You are Gistlover na
Me and you dey for police station, I dey write statement, you snap me, police told you to delete it, first of all you are not supposed to take your phone inside that station not to talk of a room where they Are writing statement, they told you to delete it; next thing, we see the post on Gistlover page and you open your soakaway and say ‘Ehh, he tell me that am Gistlover’, OGUN KPAII YOU TOO!
And guess what, since I said you are Gistlover, Gistlover no dey drag anybody online again, I don shut those ones down, I did it, now they are irregular blog, they don’t carry people’s matter again
For you to know say I don shake them, them dey even fear me, this people no post me as I dey cell, normally them dey fear, they are scared of the outcome, I said what I said, Tonto Dike that’s who you are, may the best lawyer win in court
And as for Samklef, una go dey here, Samklef go dey curse me up and down, me am not gonna sue nobody, am a public figure now for crying out loud, why person go curse me I go dey vex, no I can’t do that, I will sue nobody if you like curse my mama and my papa, na revenge I go revenge, I no go sue you na, my mouth dey, wetin you talk, I go talk
For the Police, you know we have to walk together, you people are my guys, anybody wey get problem make them file lawsuit,
police you people should stop letting all these things happen,
I dey Cybercrime, I see you people recover over 4 billion for interswitch, flutterwave… different money wey una dey recover
All these women go come carry distraction give una, yeye yeye celebrities
Pack nonsense come dey give una say na cybercrime, say that I do this
Can’t you sue
Don’t be disturbing our police for garbage
The only way this can end is if una beg me
Una tell me make I no vex
Because before Tonto Dike posted my picture, I never called her name for once
She posted my picture for what
If no be Relationship wey I get with police, I suppose sue the police for my information going out
But i aint gonna do it cause I don’t sue people, na street dem born me, we no dey do sueing
But Iyabo Ojo, make una dey go, una go go tire o
The only way is if una go beg me, ehh no vex, no vex o say we tok say your mama na animal
Then I go come say,’ehh, Iyabo, nice one my dear’
Because all those respect you don lose am because I see you like tata, there’s no respect anymore cause you ain’t got respect for yourself
So peace and love
You all gonna learn
When I say if you come for me, you are the victim, but if I come for you, you are the victim, una no understand why
It is because they fear me
Cause you all know I don’t Cap, am not a liar”

Article Source

Close